Friday 2 December 2011

Free 'Bus driver' don vex!

Im dey stay for the compound next to my own.
We dey greet once in a while.
I dey my own jeje ooo.
Na im come meet me, ask me where i dey work.
I tell am.
Im ask me how i dey take manage go work eveymorning.
I tell am say na bus na (i no get motor, person come dey ask me stupid question)
Na im im offer to dey carry me. Say make i dey call am if i wan comot.
Na so i bin dey get free ride go work inside this fine murano SUV.
Nobody talk anything wey resemble 'toasting' oo.
Yesterday, bros call me say make we hang out.
I tell am say i dey tired, say i wan go sleep.
Na im bros para, dey 'voke, say im dey tell me wetin im want make we do, me i dey talk another thing.
I no get power so i off fone. Bros show for my door. Say 'we have to talk'!
See me wahala oo. Im think say im be my bobo? Sake of say im dey drop me for office?
Abegi, make im park well joor.
I tell am say, make we leave the talk to another time say i wan sleep.
Na im bros talk wetin wan make me laff  'I cant have a girlfriend and only see her in the morning when i am talking her to work'!!!!!! 'GIRLFRIEND' KE!
Well, i swallow the laff, come tell am say i no be im girlfriend say i bin dey think say na the 2 people involved go decide to girlfriend/boyfriend each other
The guy vex, comot.
This  morning, i call am to drop me (as we bin dey do since na)
Bros no pick im fone. When im pick am, im tell me say im dey busy.
Shio! Na so?
No wahala. I go fly my bike go bustop go enter my bus as usual.

Yeye man!

Really, why do guys feel that you can be their girlfriend when they want you to be? WHy do they take women for granted? Why cant they do favours for women - no strings attached? Why do they always feel the need to get us to 'thank' them by being their babes whenever they do us favours?

Yeye!!!

6 comments:

  1. Haba... that no dey strange now....Sis and I went to Naija after 3 years. She den stumbled across one of the guys of the days of yonder who wanted to date her then. Na hin bros go memenroy lane..."You rememeber how we used to walk in the park? holding hands? (abeg, which park dey for Ibadan apart from Molete?) You rememeber how we used to hang out in my house talking about the future (my sis no even sabi say na inside house hin dey live....she bin think say na nomad)"....
    Some men are just deluded..plain and simple!

    ReplyDelete
  2. laff don finish me. chai!!!! i can picture the scene. will make a good nigerian film but yu must gree for the end sha, after e don take yu go sizzler and bar beach.lol
    best tin na i yu do, fly your bike, leave d stupid someborri. girl gini? when yu did not even "toast" me

    ReplyDelete
  3. Lmao@"decide to girlfriend/boyfriend each other" if na dis way una dey relate with bros, how im no go fall. i don fall sef but not for u sha, na for ur blog.

    Dey fly ur bike dey go jere. shio sombory. mshew

    ReplyDelete
  4. LWKMD. The guy no dey serious o. If we r to go by his means of acquiring a girlfriend, that means that for every colleague or friend that we join to work, we are automatically dating the person. *insert surprised look*. Shiooooorrr. No mind the yeye guy jor. Back to okada and buses, till you get your car.

    ReplyDelete
  5. LOOOOOOOOOOOL wow invincible relationship na im be dis oh..lol

    ReplyDelete
  6. I wish you did an update to this post..
    Did he come back to apologise?
    Do you guys still talk?
    Are you even still neighbours sef?

    ReplyDelete